Na One Whiteman Save Nigeria Expose Say CBN Dey Sponsor Boko, Ihejirika, Sheriff Dem; Nawaoh, No Nigerian Fit Expose Am Since

stephen davis arise tv

Na only Oyinbo fit save black man; no Nigerian fit do am since all these years. Nawaoh.

God bless Stephen Davis oh! Chai!

Di guy come Nigeria come open fowl behind, spill all the beans wey our President dem, Marilyn Ogar dem dey protect since.

We for never know. If to say na another person tok am, dem for say na APC, thank God say na Jonathan hire dis man oh.

So na CBN dey pay Boko? CBN wey no wan pay Doctor salary, no wan pay University lecturer money.

And dis general Ihejirika, chai, nawaoh! Na revenge for Biafra be dis? Shey da na why dem assassinate general Shuwa wey kill Biafrans for Civil war? me a no no oh. Dis tori long.

Tins dey happen fast, fast for Nigeria dese days, me I jus siddon dey look oh. Who get phone charger for blackberry 3330?

jona