Oga Minisita Adesiyan Don Comot INEC Worker From Police Station! Wishones?

busted

Make una see the two men wey dey follow INEC work for Police station. Dem catch them this morning when dem dey carry wetin dem go use vote go another place. Dem confess say na Chief Francis Fadahunsi wey be oga for PDP dem dey work for.

Oga Minisita Jelili Adesiyan, wey dey in charge of Police Affairs come call the oga for police station say make dem release them. Wishones my people?